- PagesByDami Newsletter
- Posts
- Beta thing no dey too much for here
Beta thing no dey too much for here
Say something good no mean say e no fit better pass like that😎

You’re not playing here, you be CEO!
And problem no dey finish for CEO hand
So you need get direction before you start anything.
See ehn, every move you make suppose get why
No do “because others dey do am”
Even promo!
If goal no dey, na there e go end.
You gats ask yourself:
“Wetin I wan achieve with this one?”
Because once you get goals, things go begin align.
You go sabi:
Which product to focus on
Where to show face
Best time to run am
And whether the whole thing gel for your brand
You still dey here?

Now, nne focus!
Pick what you want to achieve next.
It can be to:
Announce a new thing/service
Move your customers to another platform
Get contact of serious buyers
Clear old goods to release your space and moni etc.
And the best part?
You get what you want without another fresh work!
So what’s your next move?
Choose something with long-term gain
It’s not every time alert that will disappear like MTN data 😩
Good luck😉